Welcome to Segzycruz blogspot... Connecting You To Happenings Around The World

ASUU Strike: "We no go back down, two years no too much to sacrifice"



Nigeria Labour Congress [NLC] stage mega rally for Abuja on Wednesday to conclude dia nationwide protest.

Hundreds of Nigerian workers dey gada for di Unity Fountain inside di Nigerian capital Abuja for solidarity protest rally.

Di move na to gada support for public university lecturers union - ASUU wey dey on strike since February.

National leader of di striking lecturers declare say Academic Staff Union of Universities no go back down here until goment meet dia demands.

NLC bin give di federal goment deadline, say make dem resolve di mata wey dey cause di long strike by di public university lecturers within two weeks.



E don reach five months and thirteen days, since Academic Staff Union of Universities [ASUU] close down public universities to argue with goment ova dia welfare package.

ASUU bin start dia strike for February 14 while NLC don threaten indefinite strike if nothing happun.

Nigeria Labour Congress, a powerful umbrella union of millions of public service workers across plenti sectors, bin ask dia members to do nationwide protest on Tuesday.

Dis na di pictures for di July 27 protest inside di Nigerian capital.

ASUU President say "We no go back down"

Academic Staff Union of Universities (ASUU) don beat chest say dem no go back down on dia five months strike until govment answer dem.

ASUU national president, Prof. Emmanuel Osodeke make di vow on Wednesday to kick off di labour Mega rally inside Abuja, Nigeria.

Nigeria Labour Congress (NLC) and ASUU joinbodi protests dey happun for di Nigerian capital on Wednesday.

"We no go back down, we go fight to finish, two years no dey too much to sacrifice for generations to come" e tok

E thank di NLC and and oda Unions wey joinbodi wit dem for dis struggle as e also beg Nigerian students to dey patient wit dem.

" We beg Nigerian students to dey patient wit us, Two years no dey too much to sacrifice, dis struggle no be for only di present students but for dia children, grand and great grand children and generations to come"

"We go fight until govnors and presidents children go begin attend our Universities"

ASUU dey on strike since February 2022.



Post a Comment

Previous Post Next Post

Contact Form